*📡CAMPUS PARROT🛰️*
➖➖➖➖➖➖➖➖➖➖
*ASUP STRIKE UPDATE*
*_Di National President of ASUP, Dr. Anderson Ezeibe say di union go likely resume work afta di two week strike wey di union go._*
*Di Academic Staff Union of Polytechnics start dia warning strike on di 16th of May, 2022 to last till on di 30th of May, 2022.*
*Anderson Ezeibe say di industrial action sake of welfare go last till May thirty dis year.*
*_Ezeibe confam say goment don dey pay dem dia minimum wage arears wey goment owe polytechnic lecturers._*
*E say wen dem resume, di National Executive Council go meet and review goment response*
*And also ASUP go look at oda issues dem wey goment neva chook mouth like di revitalisation moni.*
*E say further notice on di strike go come afta di NEC meeting and dat dia tok tok wit goment since dem go strike don dey yield some positive result.*
*Wetin Asup dey demand?*
*1)Non release of di 15 billion revitalization fund for di sector 11 months afta President Buhari give approval am*
*2)Non release of arrears of di new minimum wage for 10 months*
*_3)Sustained infractions for di implementation of di provisions of di Federal Polytechnics Act wey dem amend for 2019 like di removal of rector Auchi Polytechnic._*
*4)Delay for di appointment of rectors e.g Kaduna Polytechnic, Federal Polytechnic Mubi, Federal Polytechnic Offa, and Federal Polytechnic Ekowe*
*5)Non Release of Arrears of CONTISS 15 Migration for the Lower Cadre*
*6)Fight for renegotiation of conditions of service.*
*7)Victimisation of Union Officers for IMT Enugu and Rufus Giwa Polytechnic Owo wey chop sack.*
➖➖➖➖➖➖➖➖➖➖
https://thenationonlineng.net/asup-suspends-strike-directs-members-to-resume-work-monday.

0 comments:
Post a Comment